PDP for Lagos State don ask the Chief Justice for Naija, Justice Mahmud Mohammed, make he help dem look into how court no dey gree give bail to dem party national megaphone, Chief Olisa Metuh, wey dey court date of say he collect N400m from the office of the National Security Adviser. And no be today wey he don dey cry, dey beg the court say he wan go obodo Oyinbo go collect treatment. PDP say for the spirit of democracy and freedom, make dem allow Metuh too make he enjoy him fundamental human rights. When dem dey beg the CJN for one statement wey dem throway on Sunday by dem own megaphone, Gani Taofik, the PDP ask Mohammed make he yarn him mind as dem no dey gree give am bail wey he dey ask for. The party say sake of the kind family wey Metuh get for Naija, he no fit run away bcos he no wan come court.

Monday, May 30, 2016
PDP FOR LAGOS DEY BEG CJN MAKE HE REASON OLISA METUH BAIL PALAVA
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment