Ondo State Governor, Dr. Olusegun Mimiko, don say na God go give man wey Sabi well and wey get beta mind wey go collect work from him hand as Governor for the state.The governor say Ondo State no go enter reverse go Egypt again. Na for Akure, he yarn dat for one thanksgiving service wey dem take celebrate 15th annual convention for the Riches in Christ Evangelical Mission Akure, on Sunday. For one statement wey dem throway by the state Commissioner for Information, Kayode Akinmade, Mimiko say God wey make his own election very peaceful go make say the November 26 governorship election for Ondo State go dey very peaceful too.
Ekiti State Governor, Mr. Ayodele Fayose, wey dey for the event too, advise Ondo State pipu, make dem vote for person wey go continue the good work of Mimiko. Fayose warned the pipu for the state make dem no repeat the mistake wey Naija pikins do for the last presidential election.

Monday, May 30, 2016
MIMIKO SAY NA GOD GO PICK PERSON WEY GO COLLECT GOVERNOR SEAT FROM HIM HAND
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment