Some Pipu wey sabi Law plus economy mata don carry beta hailings give we presido as he no gree mention names of pipu wey thief we money for Naija and how much dem don see collect. The Presido for one interview for London, when he go for anti-corruption summit wey l British Prime Minister, David Cameron, arrange for time wey no too tey, promise tolls he go polongo the money wey dem don see collect yesterday for him democracy day yarnings. But Buhari, change am for the full Naija pipu yesterday wey be Sunday, when everybody open mouth for front of dem TV dey expect to hear names wey presido go mention, sake of say Baba no gree talk go dat side at all, instead he just sama dem anoda promise say the Ministry of Information and Culture go dey polongo everything wey we wan hear and na from time to time dem go dey yarn us. He just say money wey plenty na him dem don see collect. Buhari say when dem finish everything wey dem suppose do, dem go put the money for we country pocket and dem go spend am wella wey everybody go see wetin dem take am do.
No comments:
Post a Comment