Monday, May 16, 2016

OYA NA... FEDERAL GOVERNMENT AND LABOUR GO DO MEETING TODAY ON TOP PETROL MONEY

We Federal government plus dem Ogas for the Nigeria Labor Congress NLC plus Trade Union go do meeting today May 16th to yarn about the strike wey Labor Congress dey plan. Dem Ogas for Labour on Saturday May 14th don give  FG till midnight for Tuesday May 17th to enter reverse carry petrol money back to N86.50 abi make dem burst kasala by way of aluta on Wednesday May 18th. Tori yarn us say dem go gather do meeting today for the office of the Secretary to Government of the Federation for Abuja by 10am.. PIPU wey suppose dey the meeting na Minister of Labor Chris Ngige, dem Ogas for NLC, TUC, NUPENG plus PENGASSAN.

No comments: