One lady wey her name be Vera Ikediala wey dey work with Bethelmendels Int'l Ltd as dem admin Manager nahin her oga give am cheque say make she cash N45,000 for Olowu Ikeja branch of First bank. The cashier con pay am across the counter, in 1000 naira note. But because say she dey hurry she no count the money. So wen she con enter office she carry the money give her oga wey con see say the money na N50,000, instead of N45,000. Tori yan say instanta nahin the lady waka go bank go drop the N5,000 back to the cashier. Dem yan say as the lady enter bank, the cashier no even notice say she over pay ontill the lady explain give am. As the cashier dey thank her na hin some pipu dey yan say if na dem den nogo return am.
No comments:
Post a Comment