National Human Rights Commission don yarn on Thursday say dem don yarn order. Make dem shine beta light on top how dem torture one 20-month-old small pikin, Musa Murtala, for Kano State. One statement wey dem sama pipu from dem Chief Press Officer, Mrs. Fatimah Mohammed, say the pinshure wey make person mind cut na him dey for one newspaper on Wednesday. Mohammed say the baby no well at all and he dey bed for Murtala Muhammed Specialist Hospital for Kano State. She say the baby mama, Bilkisu say dem carry the baby go hospital sake of say him bones don break for pieces for him hand plus legs, dem cut part of him tongue, ddisclosed that her him blokos come still give ma injury for eyes. She say the Executive Secretary for the NHRC, Prof. Bem Angwe don talk say dem get interest for the mata O, so make dem shine beta light put.

No comments:
Post a Comment