Friday, May 27, 2016

HALLELUYAH!!! SEE BLESSING WEY GOD SAMA GBENRO AJIBADE ND HIM WIFE O

Miss Simplicity - Osas nd Gbenro Ajibade wey meet nd sharperly fall in love wen dem two dey for d set of one hit TV series, Tinsel nd wey marry last yr July na tori dey nack our hand sey Baba God o don use belle take bless dem o, dat is to sey dem two dey expect their first pikin o. Na wen Genevieve magazine bring out their June issue naim d news of Osas Belle take com out o base on sey na Gbenro nd Osas dey d cover pinshure o nd Osas tok sey she bin kip d pregnancy as secret make pipu for no put bad eye for her belle o. 


Hmmm!!! Na correct yarn be dat, person need to dey use brain dey do tins o bcos "Aye 'le. Anyway we for TPN dey hapi for una o nd we dey pray sey make Baba God o, make He protect u nd d belle wella o ma'am Osas nd wen d time reach wey u go born, make water no many pas blood nd make blood no many pas water, make every tin go smoothly oooo.



No comments: