One report wey commot on Thursday from United Nations Development Programme wey dem collabo do with Oxfam Nigeria show say 46 per cent of house for Naija North-East dey borrow money take chop ni. And 61 per cent of pipu wey dey stay for the area no dey see beta water drink. As we Sabi say na 6 States dey for North-East for Naija, dem be, Adamawa, Bauchi, Borno, Gombe, Taraba plus Yobe. The report wey dem call "Livelihoods and Economic Recovery Assessment 2016" wey dem sama us for Abuja, come afta Oxfam Nigeria don do some kain finding on behalf of the UNDP for 4 states (Borno, Adamawa, Gombe, Yobe), 8 local government areas, 24 wards plus 3,258 sampled households. For inside the report, 30 per cent of the house wey dey dat region ni dey do anything for the economy, 86 per cent dey spend pass wetin dem dey make, 55 per cent no get where dem dey free demselves and dem socio-economic situations no follow at all. Other things wey dem see for the report na say One person wey dey work for one house na him dey carry the bukata for 2.3 members of him family wey no dey do anything.

No comments:
Post a Comment