One 44-year-old woman, Mrs. Rita Aiwelera, wey gun men kidnap for Ugbowo wey dey Egor Local Government Area for Edo State na him dem don release. We hear say the victim, one nurse wey dey work for the University of Benin Teaching Hospital, na him dem don release around 10pm last Saturday, afta like one week wey dem kidnap am. Tori yarn us say say na for front of her children dem move her for Igun-Owina around 7:45pm last Sunday.
The kidnappers, wey force am enter one Toyota Highlander car, come dey ask for N10 million before dem go fit release am.
The family say dem go report the mata for Ekiadolor Police Division and dem later transfer am to the State Criminal Investigation Department. We hear say the mata even cause Aluta by members of the National Association of Nigeria Nurses and Midwives, wey do Aluta say make dem release her sharperly. The good news be say dem sha don free her after dem negotiate, but we no Sabi maybe dem pay Abu dem no pay. Wetin concern is be say Mama Nurse don show.

Monday, May 30, 2016
ALLELUYAH...BADT GUYS DON FREE NURSE WEY DEM KIDNAP
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment