Monday, May 23, 2016

LWKMD.... AS APC DON CHANGE AM FOR US... SEE WETIN POPULAR IBADAN DJ DON CHANGE TO



If you Sabi anything at all about entertainment for Ibadan,  den you must Sabi DJ AY. The bros don tey and he dey scatter anywhere anyday any time with him turn table. He don play for some of the ogbonge clubs and radio stations for Ibadan, presently he dey play for Splash Fm wella. Na him make me shock when I see DJ AY on Facebook today wey take one cloth like blanket do hijab, come dey beg presido make he send him pipu come gat am, sake of say him na Chibok man part of dem Chibok girls wey dem kidnap, so he too wan see inside Aso Rock, he go like follow Sai Baba snap selfie and he no go mind if Brown Envelope fit follow am..... Walahitalahi I no Sabi say DJ AY don turn Comedian oooo..... Dis  na truly Era of change for Naija.... see the post after dis cut




No comments: