Monday, May 23, 2016

HMMM.... FANS PARA FOR 'PROUD' HUMBLE SMITH AFTA HE UNFOLLOW DEM FOR INSTAGRAM

From wetin some of the fans yarn,  e be like say the name Humble Smith na just real name, the guy no really humble like Dat. Abi wetin fit make am dey unfollow him guys wey don follow am dey since tey tey before he blow. Many of him fans just change am for am immediately dey YAB AM,  say he never even reach top he do dey raise body for dem. Some say if na so Davido do am no, shey he for reach where he dey now. Cos e sure dem die,  say even Davido no go just wake up dey unfollow him fans like dat. But the guy never respond to all dem para sha.... Some say dem even dey chat for DM before but mhen level Yaff change and Humble Smith don turn Proud Smith.

No comments: