Friday, May 20, 2016

BET 2016....CHECK OUT WHO AND WHO DEM NOMINATE FROM AFRICA

BET Networks don polongo pipu wey dem nominate for dem 2016 'BET Awards' again wey go shele for Microsoft Theater, Los Angeles, California, on Sunday June 26, 2016. This year,na 8  artists from Africa dem nominate. 3 of dem na from South Africa dem be AKA, Cassper Nyovest plus dance/house star Black Coffee. Base in say Naija no dey carry last 2 of we pikins dey there, Wizkid wey don win the award before in 2012 plus Yemi ALADE, Diamond Platnumz from Tanzania, Ghana's dancehall/R&B queen Mzvee plus Cote D'Ivoire CoupĂ© DecalĂ© star Serge Beynaud. All of dem go dey drag same award for Best International Act (Africa) Category.

No comments: