Thursday, October 1, 2015

AS EDMUND OBILO DEY GO, NA SO TUNDE OLAWUWO DEY LAND FOR NAIJA

E be like say as I dey post am, na so Corper Tee dey land for Naija, cos from wetin I hear, na the day wey I yarn una say he still dey flex for obodo oyinbo gangan he show for Area. So as he don come back, na make he declare for boys remain abi no be so? But as him dey return, na so we hear say Big Boss Edmund Obilo too don fly go New York City, as him too follow dem attend the UN Summit wey dem finish for time wey no too tey. But he be like say Oga voices still get some things to arrange for dat side as he never come back, abi he wan flex small ni? Any which way, make he sha enjoy himself. Welcome back corper Tee.

No comments: