Monday, May 23, 2016

ALLELUYAH... DEM DON FREE SISTERS WEY DEM BIN KIDNAP

After dem don  spend seven days for bad pipu dommot, the two Reverend sisters plus dem driver  wey some big bros kidnap don free yesterday. The sisters wey dia name be Perpetual Apo plus Roseline Familade with dem driver, Zwugwa Zibai, for May 15, 2016, nahin  gunmen along the Benin-Ijebu Ode Expressway while wen dem dey travel to Ogun State for a programme carry dem. The Ondo State Police Public Relations Officer, Mr. Femi Joseph, com tok say the rescued victims nkooo dem dey good health. He com dey yan say na police rescue dem but hin no yan has the rescue take go. E con dey yan say the intelligent squad sent by the Inspector-General of Police from Abuja na dem rescue the victims. last last he con tok say dem catch the bross dem but say police dey ontop dia mata plus say very soon dem go get them .

No comments: