Governor Ayodele Fayose of Ekiti State don stop cows from make dem dey waka anyhow and pipu wey dey train dem, he say anybody wey wan train cow make dem go get compound for dem.
Fayose yarn all dis when he go hail dem for Oke-Ako for Ikole local government area for the State, where last Friday some Fulani malu pipu do kpain 2 pipu and woundjure others, he still say he go do one bill wey go make am criminal for anybody to dey carry cow Waka from one place go anoda place, say he go soon send am go dem State House of Assembly. Governor Fayose come clear dem say any cow wey dem see dey waka any how, na seize dem go seize am. He say the Fulani pipu wey hayaj pipu for Oke-Ako plus other communities for Naija na agents of devil wey we suppose find com out make den punish.

Tuesday, May 24, 2016
FAYOSE SAY NA SEIZE DEM GO DEY SEIZE COWS WEY WAKA ANYHOW FOR EKITI
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment