E be like say Papa Tosibe, Alhaji Qudus Abass Akande wey everybody sabi as Obesere and him promoter, Bello Abefe don enter same trouser on top him video for Ebulesua wey don enter Internet one kain one kain. Alhaji Taofeek Bello Abefe, wey be the CEO for Solid Worth Entertainment, say the thing pain am O say Papa go drop the video of the song online feels betrayed and dat no follow wetin dem agree. Tori yarn us say agreement wey dey between the two of dem na say the promoter go release Ebelesua, plus other videos for inside the album. A d na Dat agreement make the promoter dey press 'P' reach say him go carry the mata reach court. But Sha O, Papa Tosibe don talk say him no sabi anything about how the video take manage climb Internet. He say no be him and he believe say the director wey the video dey with no fit do Dat kain thing sake of say him trust am wee as e be say dem don work together for 5 years now and Dat kain thing never happen before.
No comments:
Post a Comment