We Presido before for Naija, Dr. Goodluck Jonathan don loud am yesterday say he no run away from Naija O, wey Oyinbo dey call self-explanatory. He say he no run go Côte d'Ivoire as some kain yeye report dey carry am. As e dey talk na so pipu wey be him padis dey talk am, say he no get wetin wan make an run commot from Naija at all. One of him political padis, Mr. Yinka Odumakin, wey yarn to Vanguard afta he yarn with Dr. Jonathan say GEJ yarn am say he no run away o and e no make sense make pipu just dey lie for him head say he run when he never run. He say since he commot from government, he don turn private citizen and he fit go wherever he like as per say na peace he dey promote round the full world now, especially Africa.

Tuesday, May 24, 2016
GEJ SAY I NO RUN AWAY OOOO... MAKE UNA STOP TO DEY YARN DUST
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment