Tuesday, May 24, 2016

AGATU PIPU SAY IF GOVERNMENT NO REASON DEM MATA, DEM GO...

Pipu wey come from Idoma Land for Benue State yesterday don halla on top security measures wey no stand well for dem area, dem say upon all the promise of Federal Government to do something on top how dem take pafuka lives and properties by malu pipu, those badt guys still dey four villages for Agatu land.
The pipu wey dey yarn under the aburada of One Idoma Initiative, warn say if federal government no do anything on top the mata, the pipu fit no get choice pass make dem defend dem self. The Oga for  the group, Paul Edeh, yarn so for the Agatu Peace Concert wey dem do for Abuja, to take preach peace and gather money wey dem go take rebuild Agatu Land,  he say the concert na to make sure say the Agatu Massacre mata no commot from pipu mind, so everybody plus government go do wetin dem suppose do. Anoda of dem Oga, Mr. Moses Paul say e too bad O, say e take dem governor almost 7 weeks to go the village after the kasala wey burst.

No comments: