Nollywood actor, Chinedu Ikedieze,wey everybody know as Aki,
don shout come out o say na lie be the rumour o say him don yarn him padi,
Osita Iheneme (Pawpaw) say make he pack commot for the house where both of dem
dey stay, dem say na laff the short man take the matter laff o say nothing like
that dey happen between dem o. He explain say na the owner of the property wey
dem dey stay say him wan use him thing and that na why pawpaw pack commot.
When he dey yarn, he say we no be twins o, me na from Abia
and him na from Imo. We just be padi jujuju, e no bad if we waka now o, so far
say we still dey very close. He say he dey always happy to work with pawpaw o,
say the way dem take meet sef na God arrange am.

No comments:
Post a Comment