Miss Simplicity - E don tey wey we see Sunkanmi Omobolanle wey be Oyo state-born actor nd role interpreter for our screen nd wen dem ask ham for one interview sey y he face scarce like fuel, he tok sey na bcos him no see gud script o, he tok sey him dey like challenge o bt na so so bad boi role dem dey give ham nd him don tire, Sunkanmi come still tok sey make him fans dey ready o as him go soon sama dem wit one film wey he call " The Knot" o.
Many actors nd actress lik Ayo Adesanya, Saidi Balogun, Bimbo Akintola, Gabriel Afolayan nd plenty ogbonge pipu naim tanda for d film o. He tok sey he spend over six million for d film o nd him go release ham soon... Ovokwor una dey see moni? Hmmm make we dey wait sha to see wetin dem use over six million do o as dem tok sey d film go bad gan-annn
nn....
No comments:
Post a Comment