Miss Simplicity - Kim nd Kanye West naim land for Rome yestaday aftanoon afta dem bin go do weekend for London o. Kim wey be 35 yrs old naim make sure sey d cloth wey she wear show all her curves o, she wear one brown zip-up dress wey bring all d curve out nd wen she dey sign autographs for her fans, she do d tin wit beta posture... Avokwor, dem dey tell person? Dis one no be seere seere o, dis one no be sey weda dem shoot bird nd d mama fly nd dis one no be sey weda monkey go market nd e no come back o, dis one dress to kill tins. I sure sey Kanye West go dey feel proud as he dey waka for him wife side o, e go dey thank Baba God for d fine wife wey Him give ham oooo. Make una see d pinshures afta d cut...
No comments:
Post a Comment