Office of we Presido yesterday don change am for Lagos State say Presido Muhammadu Buhari no dey come dem side again as dem plan am for today and tomorrow. Na Vice-Presido, Prof Yemi Osinbajo, go come represent Presido for Lagos, na so Senior Special Assistant to the Presido for Media and Publicity, Garba Shehu yarn. Sheu say Presido dey face wahala as per how to arrange him Waka, na him make am change him mind. Dem say he need more time for Lagos and Edo. Sake of dat, na VP go come represent am now and he go commission some projects come leave others for Sai Baba, wey go come afta Ramadan, wey go start for June 6. Tori yarn us say even some of presido pipu don reach lasgidi before dem hear tori say Baba don change him mind.
No comments:
Post a Comment