Miss Simplicity - Nu People Magazine wey be dey bring their premier digital magazine every two months don sama us wit May/June Magazine nd na Peace Hyde wey be TV personality, Forbes Africa Correspondent nd wey d founder of leading education foundation Aim Higher Africa naim tanda for d cover of d magazine o. Peace Hyde sama d public with her curve for d magazine o nd she tok abt her life journey o nd hw Baba God don bless her wey she take be d face of d new Forbes Africa TV platform wey dey host one TV show wey be "My Worst Day Peace Hyde" in fact many (see more pinshures)
gist abt Peace Hyde boku for inside d magazine. Na William Quartey naim do d photography, Ejiro Amos Tafiri naim design d clothe, Rachel Frimpong naim be d Creative Director o. Na Edwina Sarpong Bonsu be d stylist, JMS Beau naim do d hair bt na Jembie Pro naim com sama d face wit makeup to complete all d oda pipu work nd make I no lie o, d face make sense....




No comments:
Post a Comment