Friday, May 27, 2016

(FOTO) ADONBILIVIT... SEE WETIN YORUBA ACTOR, IJEBU AND FINE BABE TAYO SOBOLA DEY DO



Miss Simplicity - Adedimeji Lateef wey we knw for him lover boi nd gentleman roles for Yoruba films nd Olatayo Amokade wey we knw as Ijebu bcos of d way he dey use Ijebu accent dey do funny funny role for Yoruba films don change dimension o, for d new film wey Tayo Sobola wey be one ogbonge actress dey produce, na woman naim Lateef nd Ijebu dress like o. D film wey e name be "Ise-Won" naim Tayo tok sey na correct film wey she still dey cook for fire o bt sey wen e done finish, pipu go gbadun ham wella o. (see plenty pinshure afta the cut) 


 Dis one no be d first time wey Ijebu go dress like girl for film bcos he do ham for him film "Abami Eda" bt na d first time wey lateef go com out of him lover boy role oooo nd I knw sey him go finish work base on sey him na one actor wey knw wetin him dey do...Tayo Sobola don tok sey make wey dey expect d film o, so me I sidon dey look nd I expect make una sef dey wait o bcos d film go bad gan-an....

No comments: