Justice M. N. Yunusa for the Federal High Court wey dey siddon for Enugu don send Col. Eugene Okpala (retd.) go prison make he go do 7 years for prison sake of say he do bad plan with pipu, and he still do jibiti wayo go collect money wey be like N34.5m. The badt guy go 419 one church, Dominion City Church in 2010.
EFCC for one statement by dem megaphone, Mr. Wilson Uwujaren, say the 62-year-old bad guy na hin suppose dey court on Wednesday but the mata gats change when case the retired Colonel say he wan change wetin he don first yarn from say him hand pure to say him hand no pure, na true he do the bad thing. Tori yarn us say in 2008, the man go meet one lawyer, Vincent Obetta, wey dey work for Igwurube Chambers and still be member for Dominion City Church say him get plenty land wey dem he wan sell for N40m. Dominion City Church, wey need land bad bad dat time sha negotiate, na so dem bargain the price come N34.5m. The church still pay anoda five percent of the money, wey be N1.75m give Igbwurube Chambers as per agent things. Na when the church say make dem dey develop the land in September 2010, na him anoda Lawyer show face say the land na for Chief Philip C. Asiodu. Court sha say make Bros go do 7 years per for prison as he don gree say na true he do dem 419.
![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjvSm5GkztpfoLTNTr9tJJoQ0S0GWD4ylS7IFpNg9-NgW9D67AIgZQJ7ORpKMaHuQxxFFdBRxej7kD6Ai6cArRhdB1nrEDFzsiysQh-UQY0ONONq5l38a48iUBMsqKrZ8WZGxsR09T2Zqk/s1600-r/HEADER.jpg)
Friday, May 27, 2016
COURT SAY MAKE RETIRED COLONEL GO DO 7 YEARS FOR PRISON FOR 419 OFFENCE
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment