The two guys wey dem name na
Hassan Abidu and Yakubu Salem
don colet dia sentence for one High Court wey chuk yang for Asaba, Delta for Monday.Tori yan say dis guys dey part of one gang wey dey disturb good pipu of Ibusa community for Delta State. The herdsmen na him dem enta police hand for February 23, 2015 after one pesin grin grin police station say one suspected group of Fulani boys na hin den dey do anyhow for Power line, wey dey Ibusa, the peson still com dey yan say dem get heavy weapon. This two guys na hin dem don already enta gbege two times because say dem dey carry weapon up and down for the area by the Attorney-General of the state, dis one nko na hin com make the judge land dem 20 years plus hard Labour.
Wednesday, May 18, 2016
COURT DON SAMA 2 FULANI HERDSMEN 20 YRS FOR PRISON SAKE OF...?
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment