Friday, March 25, 2016

EEYAH!... WIKE DON PROMISE TO INCREASE CORPERS ALLAWEE FOR RIVERS STATE




The Governor for Rivers State, Nyesom Wike don take 5k increase the monthly allawee of corpers for Rivers State. Na on Wednesday the Governor yarn that on Wednesday when he dey yarn to corpers as per dem Padi wey kpain for election mata. 


HE say dem go increase money of corpers wey dey outside Port Harcourt from 10k to 15k. And those wey dey Port Harcourt go increase from 5k to 10k. He still yarn about the guy, Samuel Oconto wey kpain. He says the tag in pain am gan, he come beg police make dem find the bad pipu and see say dem punish dem. Chai... Person wey kpain don go,  now him Padis dem go come dey chop the increase. Dis life sha

No comments: