Monday, May 9, 2016

CONFIRMER CONFIRMENTO! DIS ONE NO BE SEERE SEERE O, BIMBO THOMAS GO SOON BORN PIKIN O


Miss Simplicity - Bimbo Thomas wey be one confirm Yoruba actress naim don sama us wit pinshures wey she snap for one  party wey she go for Brooklyn, New York to take confirmento d news sey she don carry belly. D actress no gree tok d pikin papa name bt na London naim d man dey stay according to d tori wey she our hand. D actress sey she dey hapi sey she go soon get her own bundle of joy nd she tok sey na afta she born naim she go take do d launching for her cloth store wey dey for Yaba for Lagos...Wow congratulobia d very Nikky of Omo Ghetto, abeg wen Nikky dey drop voice na their mama dey tok oooo...Ur head dey dia jare... See d pinshure wey she sama us afta d cut....



No comments: