Friday, May 20, 2016

JUST LIKE DAT... ICE PRINCE DON WAKA COMMOT FROM CHOC CITY

Na for June 2015, MI Abaga become Oga for Choc City wey him padi Ice Prince Zamanni turn dem Vice Presido. Even last year, his manager yarn TheNETng say Ice Prince no go ever commot for  Choc City, even when he kpain.
But e be like electric shock when the rapper wey just release new song with 'Chike ' wey he for feature Korede Bello of Mavin. Na yesterday he polongo the news when he dey yarn on top Cool FM. Everybody shock when he say 8 YEARS don Waka just like dat. Pipu still dey shock as many no believe say he go just commot like Dat. But Sha Choc City Neva talk anything on top the mata.

No comments: