Monday, May 23, 2016

BAKARE SAY PIPU WEY SAY HE NO TALK ON TOP PETROL GBEGE NO TRY

The Oga patapata for the Latter Rain Assembly, Pastor Tunde Bakare, says the Federal Government no ask plenty pipu question before e carry petrol money go up. He still say the Save Nigeria Group bin no fight argument wey dey behind how dem take commot subsidy in 2012. Bakare said him plus other groups wey dey fight for democracy do the Aluta in 2012 because dem wan former presido  Goodluck Jonathan to shine light for how dem take dey chop before dem go talk say dem wan commot am. Na for Lagos the pastor dey yarn on top the petrol mata for Lagos. Bakare, for inside him address wey he give title "The courage to do the right things," say pipu wey dey talk say he enter ghost mode on top the increase say dem no try said those who cos no be politics ginger am to join the Aluta in 2012, shey na to make Naija beta. He say wetin dey happen now different gan from wetin shele in 2012, when dem wa. Take corruption finish us.

No comments: