Monday, May 23, 2016

WIKE SAY PDP GATS FREE ALI MODU SHERIF, COS THE PARTY BIG PASS ONE PERSON

For one statement wey the Special Assistant to l Rivers State Governor, Electronic media, Simeon Nwakaudu throway, The Chairmo for the 2016 PDP, National Convention Planning Committee and Rivers State Governor, Nyesom Ezenwo Wike don explain say the party need to free Former Acting National Chairmo, Senator Ali Modu Sheriff  bcos as dem make am Oga dey cause bad Belle for the party. For one interview on Saturday night after dem 2016 National Convention for Port Harcourt, Governor Wike say All the gbege wey dem get for the party na sake of the former Oga wey be say na since dem choose am,  kasala don dey burst. He say dem gats free am cos party big pass one person. And anybody wey like the party suppose ready to sacrifice personal things for the party.  He say he bin no get any personal interest when he support Senator Modu Sheriff, as na him be best option for the time,  wey dem choose am.

No comments: