
Monday, September 21, 2015
2BABA BEG D'BANJ AND DON JAZZY MAKE DEM DO ONE SONG TOGETHER AGAIN
Shebi na 2Baba dey do byday and when persin like dat dey do parry, everybody gats Turn up ni, especially pipu wey dey make brain for the industry. So Don Baba J dey there, Broda mi Dapo, BangaLee follow dey and when D'banj show himself finish even blow him mouth organ. 2 Baba no get choice dan say make he beg 2 of dem say abeg na, for we your fans make una try do just one beta song together again..Abeg na. Tori yarn us say Broda mi Dapo, D'Banj say sure e go shele, but Don Baba no talk anything. E be like say Don Jazzy still dey vex sha. Angel Michael calm down now, make bygun be bygun and if e no buy gun make e buy bomb.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment