Wednesday, February 17, 2016

KASALA WAN BURST INSIDE WE SENATE COS DEM WAN PUNISH MARAFA

E be like say plans don dey go on for inside we Senate on to how dem wan punish  the megaphone of we Senate Presido Unity Forum, Senator Kabir Marafa, on top one kain interview wey he do with Sunday Punch last week where dem talk say he for yarn many Opata. Dem say Marafa for the interview say him support wetin former Presido Olusegun Obasanjo talk for him letter to the 2 chambers of we National Assembly, especially say make dem dey make dem budget transparent and make anybody fit get am for Naija. 

Wen house resume on Tuesday, Senator wey dey represent Bauchi South Senatorial District, Issa Missau, na him first talk say wetin Marafa yarn for that interview na falling hand and dem gats punish am so other pipu no go do Dat kain thing, he say plenty pipu don dey Halla him phone dey ask am plenty questions cos na lie Marafa lie for dem head for the interview. Senator Matthew Urhoghide from Edo South, seconded the Mata say make dem punish Marafa,  na so Senate presido carry the Mata put for the neck of Senate Committee on Ethics, Privileges and Public Petitions make dem shele light for the Mata and report back next week Tuesday. Marafa say him no dey shake O cos na Dat time he go fit yarn other things wey dey him mind wey space no gree am yarn for inside the Newspaper. But him pipu don dey warn the Senate say make dem no reason am say dem wan do anything funny O,  COS kasala go burst. 

No comments: