Femi Branch wan celebrate hin 25th Industry anniversary With "Shalanga" and vips wey follow dey dia na. Yaw and AY. Femi Branch wey be ogbonge playwright plus director, wan showcase this latest stage play "Shalanga" for the eighth edition of Yaw's annual event. The event wey we dey tok so na hin go shelle for Sunday May 29, 2016 inside Eko Hotel Convention Centre, Victoria Island, for Lasgidi. This play na him be the latest colabo wey Yaw and Femi Branch go do, other celeb wey go still show face for pakage na Phyno, Olamide, Korede Bello, Reekado Banks, Burna Boy, Solidstar, Seyi Shay, Adekunle Gold, YCEE, Naomi Mac, Reminisce, Humble Smiths, Lil Kesh, Vector plus other entertainers.

No comments:
Post a Comment