Friday, September 18, 2015
CHAI...MECCA SAY NA 70M DEM GO PAY FAMILY OF EACH PERSIN WEY KPAIN FOR THE CRANE ACCIDENT
Shebi persin wey die don waka, na how to make sure say pipu wey he leave behind no suffer, na him be the koko. Dat na why Saudi Authorities reason am make dem sama family of pipu wey follow the crane accident for dem central mosque waka some beta cash to take hold body. According to wetin dem talk na 70m Naira go reach the hand of we Naija Brodas and sisters wey kpain for the accident. Dem do well and we give dem plenty gbosa! That kain bad moment wen you dey silently wish say one of your persin go Mecca this year.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment