Tori dey yarn us say na on May 1, 2016, Naija singer, Kiss Daniel will release him first album wey he call ‘New Era’. The fine boy don polongo say he go do beta concert take launch the album on May 15, 2016, for Eko Hotel & Suites, Victoria Island wey dey Lagos. HIM Bros and padis for music wey go perform for there na, 2face Idibia, Banky W, Patoranking, Yemi Alade, Iyanya, Burna boy, Tekno, Reekado banks, Cynthia Morgan, Wande Coal, Vector Da Viper, Sugarboy, Ycee plus plenty others. Na Olisa Adibua of BEAT FM go anchor plus other comedians like like, Ay, Akpororo, Ushbebe, Sheyi Law plus Pencil and na him padi Dj Shabzy go sama dem correct music dat day.
No comments:
Post a Comment