PDP don polongo say dem don close down dem official Twitter account. Oga far PDP Publicity Division, Chinwe Nnorom yarn am for one statement wey dem put for dem Facebook page yesterday, Tuesday, April 19 say dem official twitter handle wey be @PDPNigeria, na him some bad pipu don chuke hand sometimes last year and dem throway statement dat time to warn pipu say make dem shine dem eyes O. But as e come be say dem still don dey take the handle do nonsense again, dem don polongo again say dem don close down the twitter account. So anything wey una read from dat handle @PDPNigeria no be wetin dey PDP mind o. She say very soon dem go polongo a tear rubber twitter account. Shey una don hear O!
No comments:
Post a Comment