Nollywood actor, Femi Adebayo wey be pikin for Adebayo SALAMI, wey everybody sabi as Oga Bello, don dey polongo again O, say na him Papa make am be who e be today O. Femi career with that of him brodas, Sodiq (Production Manager) and Tope Adebayo (Movie Director), wey dey all make brain for movie industry na him dem Papa hand don push wella. For one interview wey he just do for The Nation, Jelili don sama him Papa, Oga Bello beta praise cos the Papa still get mouth wella for the movie industry. He say na play he first dey take am do before he one take am serious as profession, base in say na Lawyer he bin wan become and na wetin he go school for be dat but he come see say he dey feel the entertainment beta, na so he just say make he turn Mario for there. He say if he get chance to one dis world again, na him Papa he go still like make he born am bcos over humble dey worry the man and all the leadership things wey we learn for him body we dey take live our own life. So he carry 85% of him success for life give him Papa. Baba Niyen.
No comments:
Post a Comment