We presido before for Naija, Dr. Goodluck Jonathan on Wednesday don show back for Naija after he don go do one month for United Kingdom plus Côte d'Ivoire. We hear say the presido before show for Port Harcourt International Airport on Wednesday before he come face him village, wey be Otuoke for Bayelsa State. Tori still yarn us say he land for Otuoke around dat kain 9pm. One of him PADIS wey say make dem no mention him name say na true he don land, cos dem don even yarn for phone. Make we no forget say na on May 23, JONA dey Loud am say na lie O he no run commot Naija go Cote devoured, as one newspaper talk am say he don run go hide for dat side as he dey try hide from EFCC make dem no see am carry. So as he promise say he go soon show once he finish wetin he go do, he don show back. We say Oga JONA welcome back.

No comments:
Post a Comment