PDP for Edo State don Loud am say the state government don gree make dem pay 75 per cent mobilisation money make dem take buy medical equipment for the Central Hospital wey dey Benin, and say wetin dem dey do no follow Edo State Public Procurement Agency Law, 2012. Dem Publicity Secretary for Edo PDP, Mr. Chris Nehikhare, yarn journalists on Wednesday say na on January 14, 2016 Governor Adams Oshiomhole don sama dem confitmento make dem pay N1.4bn to one private construction company make e supply, install, train plus dey maintain the equipment wey dem go dey use for the accident plus emergency ward and even for the ward complex for the Central Hospital, Benin. When he dey yarn too, dem Legal Adviser for Edo PDP, Prof. Edoba Omoregie, say the state government no dey follow law as dem dey kolobi money wey dem suppose use for the hospital go the new Edo University, Iyamho wey dem just start without say dem approve am for House of Assembly.

No comments:
Post a Comment