Saturday, April 30, 2016

WIFE NA BLESSING FROM BABA GOD Oooo...IK OGBONNA


Miss Simplicity- IK Ogbonna marry Sonia Morales for June 29, 2015, nd Baba God bless d married wit one boy pikin wey him name be Ace nd d guy na 10-month-old nd tori many times dey tell us sey IK nd him wife love demselves like sey tomorrow no dey..naim make d actor come out o come tok sey him believe sey wives na blessing from Baba God o as per sey if u get good wife, nothing go go wrong o, he sey instead u go dey better oo.
Though d guy no call flavor name o bt him dey counter wetin flavor tok early dis week sey any successful musician no go fit keep successful marriages o, IK tok sey anybody wey tok sey u no fit make ham wen u marry dey lie o base on sey Sonia wey be him wife dey always support ham o... Last last he com send 


shoutout to every good woman wey dey pray for dia man o, wey dey support dem nd wey dey always hold dem wen dem wan fall oooo.
Confirmento, see true tok, abeg who tok sey women no dey understand wen dem ready to understand? Who tok sey women no knw how to support their husband nd make dia home stand gidigba wen dem ready? Abeg I throway salute to our women out there... Una head dey dia......

No comments: