Saturday, April 30, 2016

NO LET ANYBODY DECEIVE UNA, I NO DEY FOR FACEBOOK O....RMD





Miss Simplicity- Richard Mofe Damijo na one actor wey like nd care for him fans wella nd na bcos of dat naim make ham come out come warn him fans sey all those Facebook account wey get him name no be him own o, he tok sey na 419 dem naim dey use him name for Facebook o. He tok sey him bin get Facebook acct bt him don close ham since 2010 o.. He com still tok sey na only Twitter account @rmofedamijo nd IG account @rmdtheactor wey him management dey handle naim he get o, he sey make him fans block those thieves for


 Facebook o as no be him oooo. He com still sama dem wit 12 Facebook acct wey dey use him name nd picture nd wey be fake..Hmmm na wa oooo, abeg o make we be careful oooo... Thanks for d warning sir...


No comments: