Nawa O... 23-year-old Olaiya Oluwaseyi, na him dem don show him face yesterday wey be Tuesday April 19th for Ado-Ekiti Magistrates’ Court on top say he slap him babe, wey her name na Kehinde Igiebor. The court hear say the mata happen for April 15th for Omisanjana Street wey dey Ado-Ekiti. The prosecutor say Olaiya tear the babe slap because she no gree pick him call and dem come still flog her seriously join afta he see am say the babe still dey run package with anoda guy. The prosecutor say wetin he do not follow wetin we Law yarn for the Criminal Code, Cap C 16, Laws of Ekiti State 2012. Olaiya beg court say he no dey guilty sha and him lawyer beg the court to please give am bail. Dem come give am bail for N50,000 plus 2 sureties for same money. The judge come pushbutton mata forward to April 28th. Toor.... Make una dey careful O.
No comments:
Post a Comment