Friday, November 28, 2014

WE NO GET HAND FOR OGWUCHE MATA O, NAIJA POLICE CLEAR THEMSELVES.

Na wa o, Naija Police don clear dem self o say dem no get hand for the
tori wey dey circulate say the badt guy Aminu Ogwuche wey be the big
boss for the bomb wey blow for Nyanya no be terrorist again dem say
dem no know how the mata take be for the Federal High Court for Abuja,
where dem for dey run the mata.
Dem say na help dem help DSS take carry the badt guy come back from
Sudan because say Law say dem gats to get hand for that kain parole .

No comments: