Wednesday, April 20, 2016

OYA NA... SECOND WIFE FOR SOKOTO STATE GOVERNOR DON SAMA US HER OFFICIAL PINSHURE

Hajia Maryam Mairo, wey be second wife for Sokoto State Governor, Aminu Tambuwal don release her own official pinshure yesterday on top her programme, wey oyinbo dey call pet project, Facebook page. Wetin dem write on the pinshure be say Wife of the Executive Governor of Sokoto State. Na so pipu wey like to dey cause gobe for Facebook, Mirna Aliyu come go talk say she be first lady and na sharperly one of her pipu come swear the mata say Madam no be first lady O, she be wife of Governor. Na wa o... We dey talk say make dem scrap office of first lady,  now anoda one don show face, office of the wife of the Governor, after one we go get office of wives of the Governor. But na only pinshure she snap sha,  we never hear say she open office with government money.

No comments: