Person wey share the photo for Twitter say dem gather hand waste one guy yesterday, sake of say him and him gang go thief Generator & Television around Mararaba for Abuja. Person wey get wetin dem thief shout, na so the guys try to tear race but na only 2 of dem fit escape, God come for himself catch one
of dem. Na him dem catch, flog am so tey, dem carry firewood roast am. For inside the pinshure, small pikin just stand for the road side dey look the dead body wey dem just roast come abandon for side of the road. May God help us for this country cos our blood too dey hot sometimes and we no even dey reason wetin we dey expose we children to.
No comments:
Post a Comment