Wednesday, April 20, 2016

5000 PASTORS FOR JAIL ... EL-RUFAI DEY READY O.. PFN DEY PARA

Pentecostal Fellowship Of Nigeria for Kaduna State don yarn on Tuesday the over 5,000 Pastors wey dey PFN do obey God instead make dem obey the Law wey dem wan take control preaching wey dey front of state House Of Assembly. Dem PFN chairman, Prof. Femi wey dey yarn for one kain meeting say make dem state government dey ready to put the over 5,000 pastors for the state inside prison, if dem bone everybody pass am enter law and say the thing go cause katakata if e grow to become law. Dem say the thing no go make sense of dem no use brain do am well.  The Kaduna State Governor, Mallam Nasir el-Rufai, sha don dey warn religious leaders make dem no allow the thing turn politics. El -rufai say the Law wey he wan pass na to make peace dey O,  he no get mind to disturb anybody.

No comments: