Thursday, April 14, 2016

(FOTO) DUBAI WAN BUILD HOUSE WEY GO TALL PASS FOR THE FULL WORLD

Meanwhile we still dey find who be the I winsh wey dey drink our petrol for Naija, and the ogbanje wey dey spoil our road, dey cut our light. Dubai ni dey look back at all for dem own hustle to make dem country beta. Now dem don ready to build one kain tall building wey go tall pass the one wey get tall pass for now, wey dem dey call Burj Khalifa, wey be say na him tall pass for this full world. The building wey dem go call The Tower for Dubai Creek, go start for the end of June dis year and dem plan say dem wan finish am before Dubai go host the World Expo for 2020. Tori yarn us say money wey dem go take build am go be around dat kain $1 billion but na small e go take tall pass Burj Khalifa wey open for January 2010 and stands and na 828 meters e take tall. Toor.... One day one day Nigeria government too go break world record for beta thing.

No comments: