Thursday, April 14, 2016

CORRECT... DEM DON SAMA DPO BETA PUNISHMENT AS HE FLOG FEMALE YELLOW FEVER

Oga patapata for Police, Solomon Arase, don say make dem go immediately punish the DPO for  Ikenne Division wey dey Ogun State, Patrick Onwu, wey flog one female traffic warden, Anifat Bello, save of say she stop him private car for NNPC junction, wey dey IBB Boulevard for Ogun state on Monday April 11th. Arase, wey hear the gist for inside newspaper halla the state commissioner for police and say make dem go reduce the rank of the DPO to  ordered that Onwu be demoted to DSP from SP wey he bin dey before. Arase even say make dem carry him file to force headquarters for Abuja, make dem see how dem go still fit punish am join. Correct, all of una wey power dey Shack make una shine una eyes.

No comments: