Nawa O... Shey una remember dis woman wey her husband take beating design for Lagos on Tuesday April 12th? Her name na Rose Zanu, so she make up her mind to climb her Instagram page go talk reason why her husband bin flog am. Rose, wey be hairdresser say her husband dey flog her beat he want make she born more pikin. Whereas she don born one boy, one girl O, but she say na she dey take care of dem, dey pay dem school fees plus other things but now him family say dem dey find more pikins and she say lailai, she no gree. Na so dem take dey lie for her head say she dey chop Ogbodo for outside. She come dey beg pipu make dem advice am. Abeg na which kain yeye thing be Dat?
No comments:
Post a Comment